+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NECO don talk new date for SSCE exam

National Examinations Council (NECO) don announce the new date for the Senior Secondary School Examination (SSCE). The exam go start from Monday 9th 2020.

NECO bin postpone the exam for October based on the gbege wen follow the #ENDSARS protest for some parts of the Country.

For one statement wen Azeez Sani, the NECO Head of Information and Public Relation Division sign talk say “Based on say every every don normalize for naija states and FCT,the examination go continue now with new time table from on Monday 9th November 2020 to Saturday 28th November 2020.

“This new timetable go dey available to everybody, schools and the students wen wan write the exam from on Wednesday 4th November 2020.

“The timetable go dey very easy to download from the NECO official website wen be www.neco.gov.ng.

“The Council dey thank everybody and those wen wan write exam based on say dem dey patient and understanding during the period wen SSCE take chop suspension. NECO dey give everybody assurance say we go deliver wella.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM