Neighbor Shuk Neighbor Die For Badore Estate

The Lagos State Police Command don arrest one Mr. Tolulope Olowu say hin shuk anoda man die cus of where to park.

Na the Public Relations Officer of Lagos Police, SP Benjamin Hundeyin nai tell News Agency of Nigeria (NAN) on Sunday.

He say the fight happen on Saturday around 10.00 for nite p.m. for First Unity Estate wey dey for Badore for Ajah.

Lagos Police get to hear about the issue afta pipo wey dey stay the area go report the case of two men wey dey stay Gbadamosi Street to Langbasa Police Division.

Wetin happen be say the 41 years man Tolulope Olowu and 33 years Pablo get serious quarrel cus of where motor go park for dem street.

As the quarrel dey go on nai Tolulope karey knife take shuk Pablo for belle naso Pablo take die instanter.

The Police PR say dem team of detectives don go snap the place where the fight take happen, then karey the deadi bodi go put for IDH Morgue for Yaba so dat dem go know weda na the knife really kill am.

Hundeyin come still say the man wey shuk pesin die dey for hand with the knife wey hin use, dey wait for Investigation.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM