+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New Naira: We Go Investigate Who If Na Aisha Buhari Write Am

 

As e be naw some pipo don dey use mouth blow Nigeria First Lady, Aisha Buhari say she bring out tok say CBN say make pipo still dey use the old N200, N500 and N1000 till May 1, 2023.

Dem say na the Director of Communications, Osita Nwanisobi, nai bring out the statement on Tuesday February 21, say CBN nai tok so afta meeting wey dem do with Presido Muhammadu Buhari.

Wetin dey the statement be: “With wetin Nigeria dey pass through, to follow wetin Mr President tok afta inner meeting with am on the 20th of February, 2023, Dem tell CBN make dem bring back the old N200, N500 and N1,000 notes and pipo go fit use am for 70 days untill May 1, 2023.

“Make pipo kwatinue to dey use the old monie and nor fear.”

But CBN don come out to reject the tok through Nwanisobi.

“CBN just dey hear one fake news say make banks dey kolet the old N500 and N1,000 Banknotes. To make tins clear and follow wetin Mr President tok on  February 16, 2023, Dem only say make CBN bring back the old N200 make pipo use for only 60 days and go end for April 10, 2023. Make no bodi believe anytin wey nor come out from CBN about this new monie mata.

“Media pipo abeg make una check and get verification from the source first before una bring am out,” na wetin the statement tok.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM