The National Human Rights Commission, NHRC on Sunday don say dem go call Govinor Yahaya Bello of Kogi State and the Chairman of Lagos State Parks Management Committee, Musiliu Akinsanya a.k.a. MC Oluomo to ask dem why dem dey tok words wey nor good during 2023 election.
Before February 25 election, dem say Bello karey bulldozers go scatter road wey dey link to Kogi Central Senatorial District.
Other party candidates come see am say na way to use take play wayo so that INEC nor go fit karey dem materials reach there cus na that place nai Natasha Akpoti-Uduaghan wey be he strong rival come from.
While MC Oluomo for he own part dey warn Igbo pipo for Lagos make dem only come out to vote for Govinor Babajide Sanwo-Olu of APC or just kukuma sitdon for dem house.
After Tony Ojukwu, the Executive Secretary of NHRC, read hin statement about the 2023 govinorship and State House of Assembly election finish, as news pipo dey ask am kweshun nai he take say dem go Bello and Mc Oluomo to ask dem kweshun.