Nigeria Don Approve Malaria Vaccine

The National Agency for Food and Drug Administration and Control wey be NAFDAC don approve the R21 malaria vaccine wey Serum Institute of India do to take fight malaria.

Na the Director General of NAFDAC, Prof Mojisola Adeyeye, nai tok so on Monday for press briefing wey dem do for Abuja.

With this move Nigeria don be the nuba two kontri afta Ghana to approve this new malaria vaccine wey dem develop for University of Oxford.

According to Prof Adeyeye, this vaccine na to stop malaria for children wey dey from 5 months baby to 3 years old.

She tok say dem dey wait for like 100,000 dose of the vaccine wey WHO donate before market pipo go make arrangement with National Primary Health Care Development Agency.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM