Femi Fani-Kayode wey be strong member for APC don karey mouth tok again say na Atiku Abubakar nai kill PDP.
Remember say Fani-Kayode bin dey as Minister of Aviation before. Hin say Nigeria pipo get to dey for ground dey roll give Atiku as he scatter the party yakata for ground.
All this tok na for Twitter nai Fani-Kayode take write am on Friday.
You know say that Atiku mata dey for court as hin dey say he nor go gree say INEC go call say na Bola Tinubu of APC nai win the election of president.
But Fani-Kayode dey for one side dey lablast Atiku say hin make sure say PDP weak like dodo and nor fit get up again.
“One tin wey we nor fit take from @atiku, the Waziri Adamawa, na say hin use he hand do wetin no bodi fit do since 1999: he kill then come bury PDP to make sure say no bodi wake the deadi bodi of the party again. For wetin hin don do Nigeria suppose dey greet Atiku everyday,” na wetin Fani-Kayode write.