+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Be Me Say Make Dem Arrest Twitter Chude – Soludo

 

The govinor of Anambra State, Prof. Charles Chukwuma Soludo say hin nor say make dem go arrest Nnamdi Chude wey write sumtin for Twitter against am.

Na on Saturday nai tori come out say police for Anambra don arrest Chude, take am to Abuja.

While social media pipo say na cus hin write against Soludo nai make dem don arrest am.

Wetin Chude write for Twitter be say, some jaguda wey dey loyal to All Progressives Grand Alliance (APGA) dey disturb the vote process for Awada, Anambra state, to stop Labour Party make dem nor win.

“APGA jaguda dey everywhere for Trans-Nkisi, 3’3 & Awada dey tiff ballot box. LP nai dey win for the whole Anambra.”

“I nor fit remember wey we hear about tiffing of ballot box for Anambra last. This na just the worst. @CCSoludo don take us back to Mbadinuju’s time.”

But wey Soludo come dey tok about hin own side on Sunday through the mouth of hin Chief Press Seketary, Christian Aburime, say the state govimet nor know anytin about Chude.

“The commissioner of police, Anambra state police command don confirm say the govinor of Anambra state, Chukwuma Charles Soludo, CFR, say one Nnamdi Chude, Cybercrime unit of Interpol arrest am yesterday (18/03/23) for Anambra take am to Abuja today (19/03/23),” Aburime tok.

“Anambra state govimet nor get any info about he arrest.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM