Govinor of Kaduna State, Nasiru El-Rufai say wetin President Muhammadu Buhari approve na different tin nai CBN do ontop the new monie.
For wetin hin write for Twitter on Sunday night title: ‘Nigeria Update: ABC of Currency Redesign vs. XYZ of Cash Confiscation Explained’, na there the govinor take explain wetin dey.
Hin say Presido say make CBN redesign N200, N500 and N1000 but na color nai CBN just change.
El-Rufai come still say Presido say make dem allow pipo go change dem old monie for bank to get new one but CBN don cease the monie instead.
The Govinor come still say CBN print only N400 billion but kolet pass N2trn wey don already dey in circulation wey dey start the swap mata and the tin come make hunger and poverty increase for the kontri.
“This policy nor just make sense all in the name say you wan stop vote buying.
“Some State Govimet nor get choice but to karey the mata go Supreme Court and all the state govinor for APC don gree say FG must change this new policy.
El-Rufai say FG must obey wetin court tok untill dem do the final case finish.