Nor Be Binani Nai Win The Gov Election For Adamawa – INEC

No be small Nigeria film nai happen yesterday for Adamawa afta the REC officer of INEC, Yunusa Ari, call Aisha Dahiru aka Binani wey from APC say na she win the election, even wey he know say hin nor get the power to call the winner.

Normally dem suppose start to calculate the result around 11 yesterday morning, then na Mele Lamido wey be the Returning Officer nai go call the winner but the REC officer wey dey frefre go say na APC win around 9 for morning.

The result come make PDP members wey dey for where dem take dey calculate the results for Yola, just dey provoke.

Before dem stop to dey calculate the results on Saturday night, dem don already call 10 LGAs and na Binani nai dey win the govinor wey dey seat, Ahmadu Fintiri, while dem go come start with the 10 LGAs wey remain on Sunday by 11 for morning.

But Mele Lamido, wey be the Returning Officer for the election nor dey before Ari go smart tilalar call Binani say na she win.

Even Yiaga Africa, one civil society organisation say na wrong tin nai tye REC officer as he nor follow the Electoral Act.

“We don get reports of wayo calling of results from @inecnigeria REC for #Adamawa and e go against S 64 & 65 of Electoral Act 2022 & Part 3, INEC say na only Returning Officer get power to call winner.

“We want make @inecnigeria cancel that result and suspend the REC for Adamawa state, then make sure say dem protect the system,”  na wetin dem YIAGA Africa tok.

As e be naw INEC don cancel the declaration say na APC Aisha Dahiru Binani nai win for Adamawa, cus even she sef don come out to say thank you wey dem call her winner.

INEC say the REC nor get that kind power to announce winner and dem never even finish the whole tin before dem call say na she win.

Sha, INEC don call the REC and all the officials wey dem hand join for the mata, make dem come Abuja headkwata.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM