+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nor Be Wetin We Expect For The Election We See – NDI/IRI Observers

 

The International Republican Institute (IRI), National Democratic Institute (NDI) and Joint Election Observation Mission (IEOM) don bring dem own statement about the Presidential and National Assembly elections wey happen on Saturday.

The foma President of Malawai wey be still the leader of the mission, Dr Joyce Banda, on Monday for  Abuja dey congratulate Nigeria pipo as dem show face come out to vote.

The mission say even with the Electoral Act of 2022, “the election nor still be wetin Nigeria pipo want as e nor dey fair.,” Wetin Banda tok.

Banda say the way dem do the election nor good and the too much gbege make many pipo nor fit vote

NDI/IRI still say as monie and fuel nor dey e make tins hard for who dey vote and the pipo wey dey conduct the vote.

The delegation say the way dem take late come the polling unit just make tension high and the way dem come dey do secret for some polling wey crowd many.

Banda come say afta the election, wahala dey to upload the result quick to the portal make everybodi see.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM