NSCDC wey be Nigeria Security and Civil Defence Corps, say dem go still dey catch all those pipo wey dey do the fake new naira for the kontri.
On Sunday nai the Commandant-General of the corps, Ahmed Audi tell News Agency of Nigeria (NAN), say the way the fake of the new monie dey everywhere just be one kind.
He say e go beta if make pipo wey dey do fake monie just stop naw as hin corps nor go stop to arrest all this fake pipo.
Hin say only one month now, dem don arrest and even seize fake Naira notes wey reach millions from different part of the kontri.
The Commandant say wey dem dey tok to many of the suspect, dem say na as the monie mata dey hard nai make dem come dey do the monie well well.
Hin say: “Many pipo go don fall enta this trap as dem go dey do transfer to take kolet the new monie.
“Aa we don arrest this ones, e go epp us catch the odas wey dey scam pipo.”
Audi dey advise pipo make dem shine dem eyes and make dem dey do transfer with bank pipo instead.