+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Obi APC Ready To Meet You For Court – Onanuga

 

APC say dem ready to meet Peter Obi the presidential candidate of Labour Party for court as hin say wayo dey for the February 25 presidential election. Hin say dem get evidence to show say Obi pipo cus problem for South-East.

The director of media and publicity of APC Presidential Campaign Council (PCC), Bayo Onanuga nai tok so on Thursday for news conference for Abuja

“We dey wait for Mr Obi to go court if he get the evidence. Court na the way to go for civilized nation instead of to let supporters enta road dey protest.”

He still tok about the press meeting wey Obi get with new pipo say the election nor dey free and fair.

“Na cus the election dey free and fair nai make Obi Labour Party even get reach that six million votes. Say Labour Party and Obi win for Lagos, Nasarawa, Plateau, Delta and Edo states were APC and PDP be govinor just show say no wayo dey.”

He still say Labour Party win for the five South-East states wey dey under APGA, PDP or APC.

“We believe say Labour Party presidential candidate only dey make tins worst as he say the election nor get wayo for where he party win. We get to warn Obi, wey hin go court make he tell the whole world how he take win for South East and other parties nor get any tin. we get evidence wey dem dey do awa party pipo anyhow for South East.”

He say Obi nor win the presidential election.

“This na cus Obi nor fit win for this kind nation war get many religion and many tribe,” Wetin he tok.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM