The Labour Party presidential candidate, Mr Peter Obi say nor be everybodi wey dey Obidient Movement nai be Labour Party members.
The foma Anambra govinor say pipo wey join the movement dey free to vote any pesin wey dem support for govinor position.
As hin dey tok on Monday for Arise TV Morning Show nai Obi take say members wey dey for this movement fit vote the pesin wey dem know say na best for this govinorship election.
He say Obidient Movement nor be just Labour Party but group of pipo wey like the way hin dey resin.
Remember say many House of Representatives and Senatorial Candidates use Obi name take gain win for dem constituencies.