Oborevwori Celebrate Ogboru For Him Biyday

The govinor elect for Delta State Hon Sheriff Oborevwori dey greet Chief Great Ogboru the govinorship candidate of  governorship candidate of APGA, say hin na pesin wey dey follow democracy.

For message wey Oborevwori Chief Press Seketary Mr Dennis Otu, epp am sign to take congratulate Ogboru, he say he like the way hin do before and afta the election.

“I join my family, political associates, constituents, and the gud pipo for Delta State, take dey greet this great man of awa time, chief Great Ogboru as he dey do him 65 years biday,” Nai dey for Oborevwori letter.

“Na man wey get beta mind and nor dey resin bitterness for politics, nai be the first govinorship candidate to congratulate me afta the March 18 election for Delta State. Chief Ogboru na pesin wey odas suppose imitate.”

Oborevwori come say many pipo for the state know dem political road through Ogboru. And as e be say hin na business man wey don epp many pipo to get work inside hin company.

“I celebrate my broda and friend as hin dey celebrate. I pray make God add many years to am with good health, sound mind, boundless joy, manifold wisdom, and prosperity.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM