The chairman of Esenaebe community for Bomadi-Overside inside Bomadi LGA, Chief Romeo Bozimo, yesterday say as Oborevwori win the govinorship election for the state e truly show democracy.
Bozimo wey pipo still know as Orubebewosowoso 1 of Niger Delta, say the pipo for hin community happy wey dem hear say na Oborevwori win.
He say hin and he community, Esenaebe, dey greet Rt. Hon. Sheriff Oborevwori as hin dodge all the obstacle for he way take win, he say that one na just divine.
Bozimo come say as Oborevwori don be govinor elect, he dey believe say all the tins like light, gud water, road join with odas wey dem dey cry for, go come.