Govinor Ifeanyi Okowa say the way Sheriff Oborevwori take win for the govinorship election just show say PDP nai still dey control Delta State.
Okowa say the wining just make clear the position of PDP and as pipo like the party and even the work wey hin administration don do for the past 7 years plus.
He tok say “We nor win 4 LGAs, but we fit get victory for 21 LGAs out of the 25. We get pass 120,000 votes, that one nai dey speak for Delta PDP.”
“Even though say security agencies do Dem own, we get wetin happen on Saturday for Ughelli north, one of awa strongholds and voters dem attack and wound dem. And dem come cancel election for eleven polling unit.
“Dem still shoot one of awa agents for anoda place. But with all these tins pipo still come out to vote PDP.
“With everytin wey happen the process nor get wayo. All the INEC officials, collation officials and the security agencies try dem best.”