+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ohanaeze Nor Support Short Time Govimet, Igbo Go Dey With Tinubu Swearing In

As pipo dey shout say make dem put govimet wey go dey for the main time instead of Tinubu, Ohanaeze Ndigbo, on Monday say dem stand with Nigeria President-elect, Bola Tinubu.

The Seketary-General of Ohanaeze Ndigbo, Okechukwu Isiguzoro say pipo wey dey say make dem put anoda govimet na just devil and e nor even dey for the constitution.

Isiguzoro say make DSS go arrest any bodi wey dey sing interim govimet.

Wey Isiguzoro dey folow Daily Post tok, hin say the group nor go ever put hand for any bad tin against Nigeria.

“Ndigbo nor go look the side of any interim govimet. Pipo wey dey shout for short time govimet before full one go come na just witch tinking and e nor even dey for the constitution, the pipo wey dey call for am just want put the kontri for crisis and make igbos scapegoat like wetin happen for 1993.

“Ndigbo go join the swearing-in ceremony of the President-elect, Bola Tinubu. Who dey vex make dem karey mata go court.

“We dey happy say Atiku and Peter Obi don already go court. We nor go allow any bodi spoil democracy for Nigeria.

As Isiguzoro dey cry, hin say Igbos nor go allow pipo use dem again as sacrificial lamb.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM