Okowa Don Do Hand Over Committee To Give Power To Oborevwori, Govinor Elect

Govinor Ifeanyi Okowa don put the committee wey go epp transfer tins to the new govimet for Delta state.

Information commissioner Charles Aniagwu, nai open up the mata for news conference for Asaba on Thursday.

The commissioner say na the seke of state govimet, Patrick Ukah, nai go he the chairman of the committee, while the permanent seke of Govimet House, Eddy Ogidi-Gbegbaje, nai go be seke.

He say nor be say pesin na member for this committee nor mean say e go get appointment for the new govimet wey wan come, so make pesin nor put am for head dey showmafefe say na hin right to dey the committee and go get anoda level for the new administration.

Aniagwu come still say for those wey make the election go well, hin dey give assurance say the govimet wey dey komot and the new one wey dey come, go resin dem for beta as time dey go and God sef go open way for dem blessings to come.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM