The national chairmo of People’s Democratic Party, PDP, Iyorchia Ayu, don talk say Governor Ifeanyi Okowa na brilliant statesman wen sabi talk and dey serve him people wella as hin build Ogheye Floating Market for the state.
Ayu wen talk this one wen hin dey inaugurate the market for Warri North Local Government Area con say the market like the secretariat wen Okowa build na wonder for naija and outside naija sef.
Other projects wen the PDP chairman touch na Odokun Secondary School,3-km pedestrian road wey dey link Oboghoro to Ogheye-Dimigun and pedestrian bridge wen cross Jorojoro creek go Ogheye-Dimigun, all of them inside Warri North Local Government Area.