The VP candidate of PDP and Gov for Delta State, Ifeany Okowa, on Sunday go visit the families of the police officers wey gunmen kill for Anambra.
The police wey die na Inspector Lucky Aleh, Celestine Nwadiokwu and Jude Obuh, wey dey work with Explosives Ordinances Disposal Unit for Govimet House, Asaba.
Gunmen kill dem for Ihiala-Orlu road for Anambra State as dem dey come back from Umuahia on Friday as dem go for official work.
The govinor pray make God give the family members of the police men wey die strength as the police serve dem nation well.