+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Okowa You Don Betrayed The South- Clark

 

 

The National Leader of Ijaw and Leader of the Southern and Middle-Belt Leaders Forum (SMBLF), Chief Edwin Kiagbodo Clark, don open mouth tok about wetin Gov. Ifeanyi Okowa do for the borrowing of monie up till May 28, 2023.

He say make Okowa come tok how e do the 13% Derivation Fund wey FG give the state, plus the N250 billion wey President Buhari release give Oil-producing States, or make hin ready to see hinsef for court afta hin comot as govinor.

E.K. Clark come still say make the govinor nor just border for the vice president seat as God nor go ansa hin prayers since he don betray South pipo wey suppose get the position as next president for the kontri.

For letter wey Clark write to Okowa hin say Okowa na leader wey dey force pipo do wetin hin want, the one oyibo call Dictator.

Clark say Okowa administration nai be the baba for corruption, as many issue of abuse of office even.

The senior man still say Gov. Okowa don karey gbese  put for the state and notin to even show why hin dey karey the gbese.

He come still tok say hin go write anoda letter wey go open all the tins wey the govinor dey do plus the bank wey hin dey use.

Clark come say Premium Trust Bank Ltd, don gree to give loans to Okowa even wey other banks nor gree give am loan, cus dem nor wan put bodi for wetin nor make sense.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM