House of reps ad hoc committee don reject the new deadline wen CBN put to change old money say no be im be the solution now.
The Central bank of Nigeria bin fix the deadline for January 31 for piple to deposit their old N200, N500 and N1000 notes but the CBN governor, Godwin Emefiele on Sunday con announce say presido Buhari don allow am carry the dealine go February 10.
Chairman of the ad hoc committee for the new naira swap policy, Alhassan Doguwa on Sunday for one statement say the Central bank must “follow the law”.
“No be to add 10 days make people take change old money be the solution. We wen be government committee wen constitution dey our back go only accept wetin follow constitution according to section 20 sub 2,4 and 5 of the CBN act,e no pass so”
Naija wen be country wen dey develop must respect the rule of law and the House go sign make dem force CBN Governor to appear befor the committee.”
He also talk say ”Security agencies dem and their operation especially for state level dey normally dey get cash and dem dey pay their allowance direct for election period”.
Meanwhile,the house of representative ad hoc committee don ask Femi Gbajabiamila to give warrant make dem arrest Emiefele as hin ignore the summon wen dem summon am for the naira redesign policy.