+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Omo-Agege Congratulate Bola Tinubu For The Election As President

 

The APC Govinorship candidate for Delta State, Senator Ovie Omo-Agege, and the state APC Campaign Council don congratulate Bola Tinubu wey win the  2023 presidential election.

Omo-Agege for message wey hin sign through the Campaign Council, say the victory of Tinubu na new hope don come meet Nigeria pipo.

The statement say Tinubu na real pesin wey dey follow democracy and na pesin wey hin destiny na to be president. The council say Nigeria pipo don dey follow Tinubu since wey hin be leader of National Democratic Coalition, NADECO, Senator, Govinor and wey he come be the National Leader of APC.

Omo-Agege say hin ready to work with the president-elect and to see say Delta State develope.

He come still congratulate Peter Obi of Labour Party, for how e put effort to put new mind for Nigeria youths. He say wey dem elect am as govinor both obidient and everybodi go enjoy am

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM