+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Papa And Mama Whitney Adeniran, Make Una Nor Vex – Chrisland Skool

 

After the death of one of their student, Whitney Adeniran, The management of Chrisland International High School don send no vess message go give Whitney Adeniran family afta the girl die for the skool inter house.

The Lagos State Government, the Attorney-General and Commissioner for Justice, Moyosore Onigbanjo SAN, don bin tok on Thursday say the the report wey dem get from Lagos State University Teaching Hospital show say na electric shock the girl die.

Wetin the skool come write for Instagram:  ‘‘WE DEY SORRY. The tin pain us wella say Whitney don die. We dey sorry and dey beg Whitney papa and mama. We dey beg the community we dey and Nigeria. Na big lost for us awa skool.

“We still dey beg media pipo as we nor quick tok about the mata. We nor quick tok cus as Whitney die e shock us, and we want make the family get Dem private time.

“We dey tok to dem Adenirans. We go dey with dem for this trying period. For those of una wey dey with us and the family for this period we dey grateful.”

But the skool come still go delete the post from dem Instagram page afta mama Whitney,  Blessing Adeniran say the skool nor like her piken cus afta she don die the skool still kwatinue with the inter-house sports competition.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM