The Labour Party and Peoples Democratic Party don say make Prof. Yakubu Mahmood resign as the chairman of the Independent National Electoral Commission (INEC).
For the live press conference wey dem do nai dem take say make INEC do anoda election again as e be say the Saturday election nor get head and tail for dem side.
Na for Abuja nai the parties, PDP, LP and ADC take do tok to news pipo afta dem been don already waka komot from the national collation centre where dem take dey call the total results.