PDP Wahala: No Bodi Suspend Me – Ayu

The National Chairman of PDP Iyorchia Ayu, don say make pipo nor resin the suspension wey some of the party ward executives give am cus dem say hin dey work against the party.

Ayu say dem be just despirados wey nor even know the constitution of dem party PDP.

Na for statement wey the PDP chairman sign through him Special Adviser for Media and Communications, Simon Imobo-Tswam, for Abuja, on Monday nai he take tok so.

He say the National Chairman just hear of the rumor wey dey spread, nai make dem wan tok dem own part.

“PDP National Chairman, Dr. Iyorchia Ayu, neva get any suspension from hin ward. Na some members of the Exco wey some political jogba pipo dey decieve nai just wan cus problem.

“Na even pesin wey nor see the four kona of skool nai write am give some members for Makurdi make dem sign.

“From wetin wetin we know, the document sef na wayo cus the Ward Executives na force dem take sign am or dem forge the signature.

“Even the chairman, hin deputy and legal adviser nor sign. The 14th pesin for the list too nor sign. She go NKST Ambighir go take Holy Communion.

“Up till now, up to nine members for the Ward Exco still dey for where dem hold dem for Makurdi and dem phone nor dey go.

“We dey let everybodi know say make dem nor resin the rumor. The pipo wey do am just dey yarn yarnyarnbo.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM