The management of FrieslandCampina WAMCO Nigeria Plc, wey dey make Peak Milk don beg Christian Association of Nigeria as dem go use cross of Jesus Christ take promote dem product for Good Friday, dem don komot am for social media.
The organization say dem nor mean am like that to drag the name and sacrifice of Jesus like that.
So Punch say letter wey the Executive Director of FrieslandCampina WAMCO Nigeria Plc (Corporate Affairs), Ore Famurewa write go give the President of CAN, Archbishop Daniel Okoh on April 10 2023,dem title am, “No vex for the Good Friday Social Media post wey Peak Brand do”.
“We dey still stand on awa mission to feed Nigeria pipo and still dey respect all religion dem law and the way wey dem believe.
“Once again, abeg make una nor vex and we go make sure say this tin no happen again. Abeg make una accept awa begging”, this na from Famurewa.
Remember say yesterday nai we tell you say CAN wan warn Peak Milk for the advert wey dem do for good Friday, we dey mock Jesus Christ.