Pesin Dey Threaten To Kill Seyi Law Wife And Pikin Cus Of Politics Mata

Comedian Oluwaseyitan Aletile aka Seyi Law, say Somebodi dey threaten to kill hin wife cus of who hin dey support for politics.

Seyi Law don already bin dey drum am say na Bola Ahmed Tinubu nai hin dey support for the election to be president.

He come put the screen shot of the message wey the pesin sent take dey threaten hin wife for hin Instagram hakant and the pesin still say Seyi Law pikin must die.

This na wetin the comedian write: “First of all make I greet all those of una wey call me, we don start to dey find who sent the message. I really thank una.

“For una wey think say una go use wetin happen take laugh me, abeg make you enjoy the moment for now. I nor wan ansa the pesin before but somtin happen wey make me come post am. Check the date. With God epp, when we see the pesin, I hope pipo nor go say I dey wan oppress the pesin. God bless you.”

 

 

 

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM