The presidential candidate of Labour Party, Mr. Peter Obi don karey the rulling party go court cus of the 2023 presidential election.
Obi and Labour Party say make dem give dem free hand to take check the materials and documents wey dey for INEC hand.
This wan dey happen afta Labour Party do press conference for Abuja afta the election of 25th February.
For the press conference wey Obi do, him say this one na just day time tiff and dem go use the right way take kolet am back, say na the worst election wey INEC don do since dem start to do election for the kontri.
He come say the meeting with PDP and other parties nor mean say dem don come togeda but dem just dey share idea for the way forward.
Na Independent National Electoral Commission, INEC, Bola Ahmed Tinubu and All Progressive Congress, APC nai Obi and the Labour Party drag go court.