
The pesin wey share fuel as gift for Lagos, Erelu Okin, Pearl Ogbulu, don go ansa police for the call wey dem call her na wetin Police tell tori pipo.
Police bin invite her make she come ansa kweshun why she share fuel for her coronation party for Oniru side for Eti-Osa LG, but as she nor wan come nai Lagos state police say dem go declare her wanted.
But police say “She come this morning, even sef she come say sorry for wetin she do.” wetin Police tell PUNCH.