Pipo wey dey stay for Joju inside Sango-Otta for Ado-Odo/Otta LGA for Ogun State dey protest on Tuesday say dem nor go gree as bank nor gree kolet dem old naira notes again.
CBN on Monday bin tok through dem Branch Controller for Bauchi State, Haladu Idris Andaza, say the old monie don expire as Nigeria nor dey use am again.
E say na only CBN nai pipo go fit go deposit the old monie as commercial banks no go dey kolet am again.
“Make pipo for nor doubt, we dey let una know say CBN go kolet the old monie only on some conditions. Customers fit come the bank come deposit dem monie as dem nor go fit for ordinary banks again cus the monie nor fit buy anytin again since 10th of this month.”
Cus of this many many pipo don troop outside to protest why wetin the bank tok.