Actress Funke Akindele don tok the main resin why she run komot from Twitter.
She say na cus pipo too dey curse for Twitter nai make her run but nor be say she dey fear make pipo curse her but just wan dey careful.
Na for her Twitter page on Thursday nai she take open up afta one #apexproperties2, ask her why she nor dey come Twitter like that.
The pesin as am say “Madam Funke Akindele i cite you… longest time… you run leave us here abei, wetin happen.”
Nai Akindele come reply say “Dem too dey insult pipo for this app nai make I just dey one side. How you dey?”
As different pipo see wetin she tok nai, #Odun_is_my_name come ask her if she dey fear wetin pipo.
Akindele come say she nor dey fear, she just dey take care.
Remember Akindele nai be the running mate to Olajide ‘Jandor’ Adediran, govinorship candidate of PDP for Lagos state.