The Department of State Services tok say dem don get to know say some pipo dey plan to put new govimet wey go stay for small time and stop Bola Ahmed Tinubu make dem nor swear am in as president.
For statement wey the agency release through dem public relations officer, Peter Afunanya, on Wednesday nai dem take say dem don know about the plan.
“Some pipo dey plan to put new govimet and DSS don know, the pipo wey dey do am, make dem just stop as na wahala dem wan troway the kontri put.
“This way nor follow at all for Nigeria wey get peace. The tin come dey wonder say na even afta the election wey dey peaceful for most states nai dem dey plan this kind tin.”