One dokitor Kadev Kenneth Kelvin don land for Markudi prison afta dem tok say hin go dey use internet dey find pesin trouble.
Na Magistrate Court for Makurdi nai send am to prison.
Dem say the dokitor go write for Facebook post on March 12, 2023 say hin sew the ikebe of Benue State publicity seketary of PDP, Bemgba Iortyom, afta men nack am for Abuja prison 2017.
The report tok say the dokitor dey follow one Gabriel Terungwa Shange dey tok around 11 for night on 12 of March 2023, nai he take ‘my broda, if Bemgba Iortyom wan just do anyhow just tell me, the day wey hin know say na me be the dokitor wey sew hin bumbum wey men nack am for Abuja prison for 2017 nai he block me’.
Police come say afta dem don arrest the dokitor, wetin hin tok for Facebook nai dem screenshot am as evidence, and he come gree say he really tok am.
The police say wetin the dokitor do go against the law, and wey dem even call the case, dem no make any plea.
Inspector S. O. Itodo wey be the police prosecutor, tell the court say dem still dey investigate the case.
He come tell the court to give dem anoda date so that dem go prove dem case well.