+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Catch Pastor For Abuja Wey Karey AK-47 Climb Altar

 

Police Command wey dey Abuja say dem don arrest one pastor Uche Aigbe wey dey for House on the Rock cathedral inside Abuja as hin climb altar dey preach with AK-47 on Sunday.

Na for social media nai the pastor pinsure start to fly as hin dey preach for church with the AK-47 ontop hin shoulder.

The Police Public Relations Officer for FCT, DSP Josephine Adeh, for statement wey dem bring out say na on Monday nai police arrest the pastor, join with Inspector Musa Audu wey give the pastor he gun.

The statement reads, “The Pastor wey hin message and behavior make different tok full social media , we don arrest am on Monday plus the Church Chief Security Officer and Inspector Musa Audu, wey dey on duty that day and just karey hin phone take give the pastor without any permission from police.

“We don start investigation and make pipo know how to tok make dem nor go enta kasala.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM