One police officer wey be Chief Superintendent of Police (CSP) Agaga, for Ughelli Area Command dem say hin go beat one man wey be Mr Friday Okotoko wey be driver for Matrix filling station wey dey along the East-West Road for Ughelli.
One pesin wey karey eye see say the driver na Lagos road hin dey run, he come enta filling station before Agaga the police officer wey wear only t-shirt and knika, tell am make hin move he white Sienna Toyota motor so that hin fit buy fuel.
Dem say Agaga park near pump wey nor dey work but still just wan disturb Friday space.
Afta that nai Agaga say hin go shoot the driver if he nor gree komot from the motor.
Some of the passengers wey dey for the motor come dey beg Agaga but he nor gree, say he must to deal with the driver.
Small time nai Agaga call officers come, na so dem karey the driver, the motor and the passengers go Area Command.
Guardian tok say Agaga just tok wetin nor be true to put Okotoko for fire, say Okotoko fight am come troway am for ground.
The Lagos park wey dey for Oleh, get to put the passengers wey Okotoko karey for anoda motor.
The wahala start around 9:14 for morning but the passengers nor komot from Ughelli Area Command until 1:45 for afternoon.
But the tokpesin of Delta State Police Command, Bright Edafe say the police wan come out and the driver dey hin back, he horn but he nor gree komot . He come down to show am ID card say hin na policeman and he wan komot but the driver come out start to give the police blow.
Edafe come say na police wey dem post go that station nai see wetin dey happen then come arrest the driver.
“The CSP nor even dey this Command, na one of the pipo wey dem post come cus of election. The tin happen yesterday around 2:00 for afternoon, we go karey the man go court today Thursday,” na wetin Tokpesin Bright Edafe tok.