The policeman, Inspector Ubi Ebri, wey go kill Onyeka Ibe the young business man for Delta State cus of N100 police don pursue am from work.
The tin be say na cus of N100 wey Onyeka nor gree pay as police catch am along Ugbolu-Asaba road.
Na for front of Federal Medical Centre Asaba nai all the drama Yale happen, as police shoot the young man wey dey sell phone for Ogbogonogo market for hin head die.
Cus of wetin happen pipo come karey the man deadi bodi for stretcher protest go the state police headikwata, before the State Commissioner of Police, Ari Muhammed Ali come say make dem go arrest the police wey shoot Onyeka die.
Na Wednesday 19th of April, 2023 nai dem go karey the policeman go court