Federal Executive Council on Wednesday gree to develop port projects for Delta, Ondo and Lagos with $4,713,841,477
Na the Minister of State for Transportation, Ademola Adegoroye nai tell State House news pipo afta meeting wey oga Presido Buhari do with dem finish for presidential villa.
Adegoroye say FEC approve to develop Ondo Multi-Purpose Port for Ilaje, Snake Island for Lagos and the one for Burutu inside Delta State.
He say the projects na public private partners nai go handle am and e nor go komot any chichi from fediral govimet.
Adegoroye say the Ondo port go m cost the private developer $1,480,465,253 and dem go run am for 50 years then FG and those wey run the project go dey get $50bn and $2.6bn each.
He say the port for Burutu go cost $1,285,005,818 and the pipo go run am for 40 years then and FG go get $125bn and $9bn.
The Minister still say the Snake Island Port go cover $974,185,203 and go run for 45 years with FG to dey get $18bn and $5.23bn for those period.