Habeeb Okikiola aka Portable, wey dey sing don come court to cry say hin close paddi dem don kpos am afta hin put mouth for small fracas wey dem get with his sista.
Na for Instagram story nai Portable take bring the mata come outside on Friday.
Portable put the pinsure of hin sista wey dey for hospital bed afta the friends beat her say “Olopa ma ko everybody, see wetin oke osa boiz do my big sista. Akoi big problem.”
He come still say no be small wound nai the friends put for hin bodi, and dem don be paddi for long time as na just jealous make the friends behave like that.
Hin say: “As whona dey see. This life as you dey make am, make you dey run for people. The more you grow, run from people. Dem no want your success. Dem don shook me o. Na my nigga shock me. I no know watein he use shock me o. We don gather dey back in the days. Base on say I make am, na me still dey help am. He later con nack me base on sey you dey beat my sista.”
Afta some time nai the singer come write for hin Instagram say he don tell lawyer the mata and deme go take the case to court.