+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Buhari Dey For Meeting With APC Governors

 

 

 

 

The meeting wey wan happen between President Muhammadu Buhari and governors wey dey under APC don start like this.

The govinors dey under one canopy wey be Progressives Govinors Forum, and dem dey meet with president for the council chamber inside State House for Abuja.

Why dem dey do the meeting neva clear bit e be like say e concern Bola Tinubu wey APC presidential candidate.

You know say Kaduna State Govinor, Nasir El-Rufai, bin tok say some pipo from president side dey work against Tinubu.

The pipo wey dey the meeting na govinors from Kaduna State, Nasir El-Rufai; Kebbi State, Atiku Bagudu; Imo State, Hope Uzodimma; Zamfara State, Bello Matawale; Ebonyi State, Dave Umahi; Lagos State, Babajide Sanwo-Olu; Kano State, Abdullahi Ganduje; Ogun State, Dapo Abiodun; Yobe State, Mai Bala-Buni; Niger State, Sani Bello; and Kwara State, Abdulrahman Abdulrazaq.

[Daily Post]

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM