The president wey Nigeria just get, Bola Tinubu say hin don set committee wey go follow the other presidential candidates wey contest for Saturday election tok.
Na Govinor Rotimi Akeredolu of Ondo State nai say the committee pipo na elders of APC wey go soon meet with the pipo wey contest for the election and nor win.
For statement wey Akeredolu Chief Press Secretary, Richard Olatunde bring, hin still say dem nor play wayo for the last Saturday presidential election.
Part of the statement na: “The President-elect don set committees wey go meet with the pipo wey contest so that dem go start to heal fast.
“I dey one of the committees. We go meet dem to tell dem make dem join us so that wey go work togeda.”