Protest For Port Harcourt INEC Office, As Youth Say Dem Want Check Election Result

On Monday for Port Harcourt youths don enta INEC office dey protest say dem nor go gree and as e be one pesin don injure cus of the shooting wey dey for the place.

Tori say na one security pesin wey dey work with Tonye Cole wey be APC govinorship candidate for the state nai shoot for INEC office.

The gbege start all of a sudden afta APC and PDP members jam for INEC office.

PDP members say make INEC give dem the real Certified True Copies (CTC) wey dem use for the fiber election, say dem must folow opposition party check the materials.

The protest just make hold up dey for waterline junction and Port Harcourt Aba express road.

For the oda way, PDP members say make police go arrest Tonye Cole and the security man wey go shoot innocent pesin  wey dey protest.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM