+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Security Arrest Iran Girls Cus Dem Dance To Rema Song For Public

 

Some young girls for Iran don enta soup as dem go post video wey dem dance to Rema song ‘Calm Down’.

Tori get am say dem arrest the girls come force dem make dem apologize for wetin dem do.

For tweet wey Shahrak Ekbatan write, say dem first wan the five girls before police come hold dem for station for two days, then come beg say dem nor go try that kind tin again.

Fox News report say security force start to look for the five girls immediately dem see the video wey dem do near Ekbatan the west of Tehran and pipo look am well online.

And dem say for the video the girls share am for International Women’s Day, dem come nor still cover dem head and na must for women to cover head for Iran.

The Shahrak Ekbatan Twitter account dey always tweet wetin dey happen for the area, nai tok say Iran police dey look for one girl and dem wan arrest am.

As Singer Rema dey tok about the case for hin own Twitter account he say “To all the beautiful women wey dey fight for beta world, na una dey ginger me, I dey sing for you, and I dey your dream.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM