+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Stay For Your House If You Nor Wan Vote APC For Lagos – MC Oluomo

 

Musiliu Akinsanya, aka MC Oluomo wey be Lagos State Parks Management Committee Chairman don send serious warning give Igbo pipo say dem must vote for APC on Saturday election.

For one video wey start to trend online on Thursday, show where Oluomo dey follow some APC supporters dey tok, come dey threaten any Igbo pesin wey go come out to vote and nor gree vote for APC.

The meeting so na inside hall dem do am with many pipo wey dey inside, na for there Oluomo take dey speak Yoruba say: “We don beg dem. if dem nor wan vote for us, nor be wetin we suppose fight for. Just go meet dem quietly and say mama Chukwudi if you nor go vote for us, abeg sitdon for house.”

Dem don dey point Oluomo say na hin dey cause the fight wey dey happen to the oda opposition party dem supporters.

All this one dey happen afta Peter Obi of LP win Lagos state for presidential election on Feb.25.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM