Good people rescue one lady wen jump enter river dey wan kill herself for Oghara Bridge for Benin-Warri Road.
According to tori, the thing happen around 7:00pm on Tuesday night.
One of the eye witness, Isreal Joe wen see as the girl jump nai hala make people rescue her.
“One young lady don try to kill herself about two hours ago,she jump from Oghara-Benin bridge enta river.
“Me and my guy Jay Cee dey come back from Benin when we see person jump from the bridge wen high enta river. We get to park on-top the bridge hala for help.
“Thank God say some indigenes dey under bridge, na dem con run enter river straight to where she fall put.
“We call the DPO for Oghara wen con send men to the place sharparly. Them con rush her go Oghara Teaching Hospital.
“We nor know why she do wetin she do but we hear say she be student of Delta State Polytechnic Otefe, Oghara.”