Supreme Court Judgment For Gov Adeleke Fit Turn Sword With Two Sharp Side – Keyamo

Minister of State for Labour and Employment, Festus Keyamo, dey draw hin ear dey war make pipo look well the victory wey Supreme Court give to Govinor Ademola Adeleke of Osun State fit turn to sword wey get two sharp side.

Keyamo say all those wey dey celebrate Adeleke victory, make dem open eye look the pattern wey  Supreme Court take give about the BVAS to show say over voitng happen.

He say the judgment fit even affect the Presidential Election Petitions.

Know say na on Tuesday nai Supreme Court say make dem leave mata na Adeleke of PDP nai be the real govinor for Osun State.

But Keyamo dey tell those wey dey celebrate Adeleke Supreme Court victory, to look well.

For Twitter nai Keyamo come dey write: “Dem neva even tell demsef make dem stop to check the kind way when Supreme Court take folow the case with BVAS to show say dem do over voting and how e take affect dem Presidential Election Petitions wey go still go jam for Supreme Court small time from now.

“Today Supreme Court don set the leg wey fit even turn to sword wey sharp for two side and wey I come dey tik about am, I just laugh. I dey wait for the final decision of the Presidential Election case.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM