+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Supreme Court Karey Case To Judge New Naira Go Front

 

 

The Supreme Court on Wednesday for Abuja on.don karey the case wey dem bring about the new naira and old naira to Wednesday, 22nd February 2023.

Three states nai bring case against FG make dem stop CBN to kwatinue with the policy of the new naira.

As the case dey go on nine states don join the three states wey first bring the mata come court.

Dem be Katsina, Lagos, Cross River, Ogun, Ekiti, Ondo and Sokoto states.

Even Edo and Bayelsa don say dem wan join for the case.

The 7-man panel wey Justice John Okoro dey lead say make all of dem put dem case togeda so that e go be one.

But as e be naw before dem go judge the case the other wey court give about the ban of old N200, N500 and N1000 naira notes still stand.

[Punch]

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM