+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Supreme Court Say Make Pipo Start To Use The Old N200, N500, N1000

 

Supreme Court for Abuja on Friday say make FG stop that policy wey dem put to stop the old N200, N500, N1000 , as e nor dey the 1999 constitution.

The Apex Court say oga Presido Muhammadu Buhari go against the constitution of the kontri with the way hin take do about the redesign wey CBN do for the naira.

Justice Emmanuel Akomaye Agim,  say President nor even go meet National Council of States, Federal Executive Council (FEC) and the National Economic Council (NEC) before hin tell CBN make dem bring the new monie.

He come say wetin oga Buhari do no just good and e dey against the pipo of the kontri since na democracy nai the kontri dey practice

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM