Supreme Court Shift Nnamdi Kanu Appeal, Give FG Chance To Add Nine New Case

Supreme Court on Thursday don karey the case of appeal wey Mazi Nnamdi Kanu, IPOB, leader lawyers bring come to ask for hin release to anoda time.

The court come even give FG chance make dem bring nine new case against Kanu so dat he nor go free.

This leave go join the new nine grounds as part of the amendment notice of appeal wey dem do for 28th October 2022 and na five member panel wey Justice John Okoro lead nai give FG the chance on Thursday as e dey tok about the motion wey FG lawyer Tijani Gadzali bring.

For the hearing, Nnamdi Kanu lawyer, Mike Ozekhome come tell the court about hin motion say hin want make dem bail he client and transfer am to Kuje prison so that Kanu go get beta treatment as he dey always sick for DSS station.

Ozekhome come still dey beg the court make dem quick judge the case.

But FG lawyer say make dem karey the case go anoda date so that hin go fit file affidavit against make dem nor release Kanu, say Ozekhome just take over the mata.

As the court hear the motion especially the one Ozekhome take say make dem transfer Kanu nai court say make he focus on the main appeal.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM