The Pipo Wey Expel Omo-Agege Na Fake APC Officials

All Progressives Congress for Delta State say the pipo wey expel Ovie Omo-Agege, deputy senate president from the party na just fake members wey dey form.

One set of exco wey Ulebor Issac, leader for one side of APC party for Delta, nai say dem expel Omo-Agege cus hin dey work against the party.

For statement wey Omeni Sobotie and Peter Akarogbe the Delta APC chairpesin and seketarty bring on Monday, nai say the working committee wey dem dey lead nai be the original one.

Sobotie na one of the chairpesin wey Mai Mala Buni-led caretaker committee put for February 2022.

“Na we be the real state executive committee wey the party know for national headkwatas.

“Make no bodi reason dem bad belle publication of pipo wey just want dey put problem for where problem nor dey.

“The executive committee members of APC for the wards, local govimets, senatorial districts and state levels, dem sitdon pick dem. And their office still stand with APC.

“With all the tins wey clear, the signature for the publication just show say na wayo pipo nai dey behind am. So make everybodi just dey calm.”

Dem come dey tell security pipo make dem look this wayo pipo well, so that dem nor go cause problem for the state.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM